Soldiers wey don die for Russia war pass 70,000 as volunteers make up highest number for di first time
More dan 70,000 pipo wey dey fight for Russia military now don die for Ukraine, according to data wey BBC analysed. And for di first time, volunteers - civilians wey join di armed forces after di war start - now make up di highest number of pipo wey kpai for battlefield since Russia full-scale invasion start for 2022.